Eliashib wey bi di high priest and en oda priests build di Sheep Gate, dedikate kon put di doors as dem suppose dey. Dem build go rish di Hundred Towa and Hananel Towa kon dedikate dem too.
Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part. While Meshullam wey Meshezabel pikin Berekaya born, do di next part. Na Zadok, wey Baanah born, ripair di oda part.
Hanun and di pipol wey dey stay Zanoah aria, ripair di Valley Gate. Dem ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars. Dem still ripair di wall wey bi 1,500 fit wey lead to di Dirty Gate.
Shallum pikin, Kol-Hozeh, wey bi ruler for Mizpa aria, ripair di Well Gate. E ribuild and roof am, kon fix di doors, en bolts and bars. For Siloam Pool, near di royal gardin, e still ripair di wall go rish di road wey lead to David Town.
Levi pipol wey ripair di next parts na, Rehum wey bi Bani pikin, while Hashabaya wey dey rule half of Keilah aria, ripair di next part for en aria pipol.
Benjamin and Hasshub, ripair di next part wey dey front of dia house. Zabud wey Ananaya pikin Maaseaya born, ripair di next part wey dey en house front.
Na Palal wey bi Uzai pikin, ripair di next part from di wall korna and di towa for di king uppa house wey near di guards kourt. Afta am, na Pedaaya wey bi Parosh pikin
Hananaya wey bi Shelemaya pikin with Hanun wey bi Zalaf sixt pikin, ripair di oda part. Afta dem, Meshullam wey bi Berekaya pikin kon ripair di oda side for en house front.
Malkijah wey dey melt gold, ripair di next side go rish di temple savants and di tradas house, wey dey near Inspeshon Gate go rish di uppa room for di korna side.