Wen Sanballat, Tobaya, Geshem and di rest of awa enemies hear sey wi don build di wall tight well-well, even doh wi neva set di gates for where dem suppose dey,
Dis na wetin dem rite for di leta: “Geshem tell mi sey, dem dey tok for evriwhere sey yu and Jew pipol won kom attack us and na dis make yu dey build di wall back. E still sey yu dey plan to make yorsef king
and yu don arrange with some profet make dem announce for Jerusalem sey yu bi Judah king. Naw, di king go hear about am and na dis make mi sey make yu kom make wi first tok about di matter.”
By dis time, I go visit Shemaya wey Mehetabel pikin Delaaya born, wey nor fit komot from en house. Den e tell mi, “Mi and yu must go hide for di Holy Place for di temple kon lock di doors, bikos dem won kon kill yu. Dem go kom kill yu anytime from naw.”
I kon pray, “My God, remember wetin Sanballat and Tobaya dey do, den make Yu ponish dem. Remember and ponish dat woman Noadaya and all di oda profets wey dey won make mi fear.”
Many pipol for Judah dey en side, bikos en fada-in-law na Jew wey bi Shekanaya wey bi Arah pikin. En pikin Jehohanan marry Meshullam wey bi Berekaya dota.
Pipol go dey tok for my front about all di good tins wey Tobaya dey do kon go tell am evritin wey I tok. But e still kontinue to dey send mi leta wey go make mi fear.