Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.
Mordekai get one fine kousin wey en name na Estha and en Hibru name na Hadassa. Wen di girl papa and mama die, Mordekai take and train am as en own pikin.
Wen di king kommand make dem bring girls kom Shushan, Estha dey join dem too. Estha sef dey di royal palis and na Hegai dey kare for all di king wimen.
Hegai like Estha bikos of wetin e dey do and how e dey do tins. E know waste time before e sey make dem dey trit Estha well both for wetin e wont and food wey e go chop. E give Estha di best place to stay kon choose seven girls from di royal palis wey go dey attend to am.
Dem trit di girls well for one year, dem massage dem with myrrh oil for six monts and balsam oil for di oda six monts. Afta, dem kon dey take each girl go meet di king.
E go-go der for evening kon kom back for morning, den dem go take am go meet Shaashgaz wey dey kare for di king girl-friends. Di girl nor go-go meet di king again, unless di king like am kon ask of en name.
Time kon rish for Estha to go meet di king. Estha na Abihail pikin and Mordekai kousin and anybody wey si am, dey like am. Wen e turn rish, e wear wetin Hegai wey dey kare for dem sey make e wear.
One day wen Mordekai dey work for di palis gate, Bigtan and Teres wey bi ofisas wey dey guide di king door-mot kon dey vex and plan to kill King Zazes.