|
| 1 |
|
| As last, Job kon tok and e curse di day wey dem born am. |
|
| 2 |
|
| Job kon sey, |
|
| 3 |
|
| “Make di day wey my mama born mi disappear and make di nite wey e get my belle, vanish! |
|
| 4 |
|
| Make di day turn to darkness. God! Make Yu nor remember dat day again; nor let lite shine put again. |
|
| 5 |
|
| Make darkness and deat shadow kover am! Make betta kloud dey on-top am; make darkness kover en lite. |
|
| 6 |
|
| Make dat nite komot from kalendar; make dem nor kount am join di days and monts for di year again. |
|
| 7 |
|
| Make di nite empty and e nor go get joy again. |
|
| 8 |
|
| Make di pipol wey dey curse day, curse am! Make di pipol wey dey curse wota juju, curse am too. |
|
| 9 |
|
| Make en morning star remain darkness. Even wen e find lite, make e nor si am and make en day nor break. |
|
| 10 |
|
| Make Yu curse di day wey my mama born mi, bikos na-im make mi dey face all dis trobol so o-o. |
|
| 11 |
|
| “Wetin make mi nor die before my mama born mi? Or why I nor die as I just kom out from my mama belle? |
|
| 12 |
|
| Wetin make my mama karry mi for en lap? Why my mama feed mi with en breast? |
|
| 13 |
|
| If to sey I die dat time, I for dey rest naw; |
|
| 14 |
|
| with kings and govnors wey bin build big-big house for demsef for dis eart. |
|
| 15 |
|
| I for dey rest with prince wey get gold and wey silva full dia palis. |
|
| 16 |
|
| Why dem nor beri mi like pikin wey die before dem born am? Like pikin wey nor live to si di lite? |
|
| 17 |
|
| Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil and evribody wey dey der, dey rest. |
|
| 18 |
|
| Even di pesin wey dey prison before, dey rest, bikos nobody dey opress am for der. |
|
| 19 |
|
| Evribody dey der, both small and big and even savants dey free from dia oga. |
|
| 20 |
|
| “Wetin make God dey give lite to pesin wey dey sofa? Why E dey give life to doz wey dey face trobol? |
|
| 21 |
|
| Dem dey find deat, but dem nor dey si am; dem dey find am pass wetin dey precious. |
|
| 22 |
|
| Dem dey-dey happy wen dem die go dia grave. |
|
| 23 |
|
| Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro, pipol wey God surround with wahala? |
|
| 24 |
|
| Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota. |
|
| 25 |
|
| And naw, evritin wey I dey fear, don dey happen to mi so o-o. |
|
| 26 |
|
| I nor get peace or rest and my trobol nor gri end.” |
|
|
|
|