Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| “Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok! |
| 2 |
| Si naw, I don open my mout and my tongue won start to tok. |
| 3 |
| All my words na true and na true I go tok. |
| 4 |
| Na God Spirit make mi and na en breath give mi life. |
| 5 |
| Make yu ansa mi if yu fit. Make yu dey ready and prepare yor kweshons. |
| 6 |
| Na di same tin mi and yu bi for God eye, na san dem take make mi and yu. |
| 7 |
| So yu nor get rizin to fear mi and I nor go wahala yu too mush. |
| 8 |
| “Naw, dis na wetin I hear wen yu dey tok: |
| 9 |
| ‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin. |
| 10 |
| But God dey find rizin make E for dey ponish mi like sey I bi en enemy. |
| 11 |
| E tie my leg with shain; E dey si evriwhere wey I waka go.’ |
| 12 |
| But I won tell yu sey yu dey wrong, bikos God big pass evribody. |
| 13 |
| Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain? |
| 14 |
| “Even as God dey tok evritime, nobody won wait listin to wetin E dey tok. |
| 15 |
| For nite wey pipol dey sleep, God dey tok to dem for vishon or thru dreams. |
| 16 |
| Wen E make dem listin to wetin E dey tok, dem go dey fear for di warnin wey E dey give dem. |
| 17 |
| God dey tok so dat dem go stop to sin kon honbol demsef, make E for fit save dem. |
| 18 |
| E nor go let dem distroy demsef; E go save dem from deat. |
| 19 |
| God dey send sickness to take korrect some pipol and dem go take korreshon wen dia body dey feel di pain. |
| 20 |
| Pipol wey dey sick nor fit even chop di food wey sweet well-well. |
| 21 |
| Dia body dey die go and yu nor go fit si dia bones again. |
| 22 |
| Dem go soon go join dead body. Deat angel dey wait for dem. |
| 23 |
| May bi one angel go help am; one out of di tazon angels wey God get wey go tell am wetin dey rite. |
| 24 |
| Bikos God don forgi-am, di angel go sey, ‘Release am! E nor go fit go join dead body. Si wetin dem take replace en sin, so e don dey free.’ |
| 25 |
| En body go kom yong and strong again like small pikin own. |
| 26 |
| Den wen e pray, God go ansa am. E go woship God with happiness. God go make am dey raitious for en eye again. |
| 27 |
| Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’ |
| 28 |
| E don save mi from deat and I still dey alive. |
| 29 |
| “True-true, God dey always do like dis, many-many times with pipol. |
| 30 |
| E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again. |
| 31 |
| So Job, make yu listin to wetin I dey tok. Naw, kwayet make yu let mi tok. |
| 32 |
| But if yu get wetin yu won tok, tok and I go tell yu if yu dey rite. |
| 33 |
| But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.” |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/033.mp3
42
33