Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Elifaz from Teman kon sey: |
| 2 |
| “Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again. |
| 3 |
| Si, yu don tish many pipol and give strent to doz wey dey weak. |
| 4 |
| Yor words don support pipol wey won fall and yu don give strent to doz wey don taya. |
| 5 |
| Naw wey e rish yor turn to face trobol, yu nor get heart again. Yu nor fit stand am at-all. |
| 6 |
| Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God. |
| 7 |
| Make yu tink am sef, den tell mi wish time pesin wey dey respet God, dey sick. |
| 8 |
| But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am. |
| 9 |
| God dey skata doz kind pipol, bikos E dey vex for dem. |
| 10 |
| Wiked pipol dey do like lion, but God go skata and break dia tit. |
| 11 |
| Dem go die like lion wey nor si food chop and all dia shidren go skata. |
| 12 |
| My savant kom tell mi word small-small, but I nor hear wetin e tok well. |
| 13 |
| E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep. |
| 14 |
| I fear and all my body kon dey shake. |
| 15 |
| Na small breeze blow my face kon make my hair stand. |
| 16 |
| Sometin stand for der and even wen I look, I nor fit si wetin e bi. |
| 17 |
| E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am? |
| 18 |
| If God nor even bilive en savants wey dey heaven; dey si komplain for en angels body, |
| 19 |
| yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house? |
| 20 |
| Somebody fit dey alive for morning kon die for nite, before odas go know. |
| 21 |
| Dem go take evritin wey e get and e die without wisdom. |
| Save Notes |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/004.mp3
42
4