|
| 1 |
|
| Den God tell Job: |
|
| 2 |
|
| “Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?” |
|
| 3 |
|
| Den Job ansa God: |
|
| 4 |
|
| “True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again. |
|
| 5 |
|
| I don tok pass wetin I suppose tok. I nor get anytin to tok again?” |
|
| 6 |
|
| Den from inside di storm, God kon ansa Job: |
|
| 7 |
|
| Make yu stand strait kon ansa my kweshons. |
|
| 8 |
|
| Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite? |
|
| 9 |
|
| Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own? |
|
| 10 |
|
| If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef. |
|
| 11 |
|
| Look pipol wey tink sey dem dey important, den go honbol dem, bikos yu dey vex. |
|
| 12 |
|
| Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put. |
|
| 13 |
|
| Beri all of dem for groun kon tie dem for where dead body dey. |
|
| 14 |
|
| Den na mi go first praiz yu kon gri sey yu don win di fight by yorsef. |
|
| 15 |
|
| Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu, |
|
| 16 |
|
| but si as en strent bi like lion own and e pawa dey en body. |
|
| 17 |
|
| En tail stand like tall tree and di pawa wey dey e leg, strong well-well. |
|
| 18 |
|
| En bones strong like bronze and en leg bi like iron bar. |
|
| 19 |
|
| E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol! Na only God wey kreate am go fit distroy am. |
|
| 20 |
|
| Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play. |
|
| 21 |
|
| E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass and e go hide among di reeds for di bush. |
|
| 22 |
|
| Inside bush dey gi-am betta place to rest. Di tall tree dey gi-am shade. |
|
| 23 |
|
| E nor dey fear wota wey dey rush pass like river; en body go kold wen Jordan River flow pass en face. |
|
| 24 |
|
| Who fit blind en eyes kom katch am? Na who fit use trap katch am thru en nose and mout? |
|
|
: |
| 1 | | 2 | | 3 | | 4 | | 5 | | 6 | | 7 | | 8 | | 9 | | 10 | | 11 | | 12 | | 13 | | 14 | | 15 | | 16 | | 17 | | 18 | | 19 | | 20 | | 21 | | 22 | | 23 | | 24 | 1
1
1 |
|
|---|
|
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/040.mp3
42
40