|
| 1 |
|
| “Yu fit use fish hook take katch Leviatan or use rope take tie en tongue? |
|
| 2 |
|
| Yu fit put rope pass en nose or hook en jaw? |
|
| 3 |
|
| E go beg yu make yu let am go? Or make e beg yu make yu sorry for am? |
|
| 4 |
|
| E go gri make agriment with yu kon promise sey e go serve yu forever? |
|
| 5 |
|
| Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house; or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with? |
|
| 6 |
|
| Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment? Pipol wey dey sell pesin go gri sell am? |
|
| 7 |
|
| Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish or katch en head with hook? |
|
| 8 |
|
| Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight! |
|
| 9 |
|
| Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun. |
|
| 10 |
|
| Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front. |
|
| 11 |
|
| Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own? |
|
| 12 |
|
| Make I tell yu about Leviatan leg kon tell yu how e dey big and strong well-well. |
|
| 13 |
|
| Nobody fit tear en klot wey dey outside or shuk di armour wey e wear. |
|
| 14 |
|
| Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear, kom out? |
|
| 15 |
|
| Na many shield dem take make en back kon tie dem togeda and dem strong like stone. |
|
| 16 |
|
| Dem join dem strong well-well and space nor dey wey breeze fit pass enter en body. |
|
| 17 |
|
| En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem. |
|
| 18 |
|
| Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon. |
|
| 19 |
|
| Fire and tonda lite dey kom out from en mout. |
|
| 20 |
|
| Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey kom out from en nose. |
|
| 21 |
|
| Fire dey kom out from en mout and even wen e breath, e dey bring fire. |
|
| 22 |
|
| En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear. |
|
| 23 |
|
| E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend. |
|
| 24 |
|
| En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone. |
|
| 25 |
|
| Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow. |
|
| 26 |
|
| No swod fit wound am; no spear or arrow fit enter en body. |
|
| 27 |
|
| Iron just bi like straw for en eye and bronze dey soft like wood wey don rotin. |
|
| 28 |
|
| E nor get di arrow wey won make am run, even wen dem stone am with rock, e bi like straw for en body. |
|
| 29 |
|
| Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am. |
|
| 30 |
|
| Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun. |
|
| 31 |
|
| E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot. |
|
| 32 |
|
| E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam. |
|
| 33 |
|
| E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am and I kreate am without fear. |
|
| 34 |
|
| Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.” |
|
|
: |
| 1 | | 2 | | 3 | | 4 | | 5 | | 6 | | 7 | | 8 | | 9 | | 10 | | 11 | | 12 | | 13 | | 14 | | 15 | | 16 | | 17 | | 18 | | 19 | | 20 | | 21 | | 22 | | 23 | | 24 | | 25 | | 26 | | 27 | | 28 | | 29 | | 30 | | 31 | | 32 | | 33 | | 34 | 1
1
1 |
|
|---|
|
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/041.mp3
42
41