|
| 1 |
|
| Den Job ansa: |
|
| 2 |
|
| “If dem put my trobol and pains for skale, |
|
| 3 |
|
| dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis. |
|
| 4 |
|
| God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear. |
|
| 5 |
|
| Donkey dey fear wen e dey chop grass? Abi melu dey kwayet wen e dey near food? |
|
| 6 |
|
| But who fit chop food wey nor get salt or taste? Or wish kind taste dey for di white part for egg? |
|
| 7 |
|
| I nor fit tosh dat kind food, bikos e dey make mi sick. |
|
| 8 |
|
| “Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer? |
|
| 9 |
|
| I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand. |
|
| 10 |
|
| Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word. |
|
| 11 |
|
| Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope? |
|
| 12 |
|
| Na stone dem take make my strent? Abi my body na bronze? |
|
| 13 |
|
| I nor get strent to take help mysef and all my pawa don komot from my body. |
|
| 14 |
|
| “Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not. |
|
| 15 |
|
| But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall! |
|
| 16 |
|
| Di wota dark bikos ice-blok and snow don kover dem. |
|
| 17 |
|
| But wen hot weda kom, di wota go disappear. Wons heat dey, di wota go vanish from where dem dey. |
|
| 18 |
|
| Animals wey dey pul karavan waka lost, bikos dem dey find wota and dem waka die for dry land. |
|
| 19 |
|
| Animals wey dey pul karavan wey kom from Sheba and Tema nor find dem, |
|
| 20 |
|
| but all dia hope die for dry river. |
|
| 21 |
|
| To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake. |
|
| 22 |
|
| “I don ever sey, ‘Make una give mi sometin, or make una give money to pesin for mi? |
|
| 23 |
|
| Or make una save mi from my enemy pawa and from wiked pipol?’ |
|
| 24 |
|
| “Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una. |
|
| 25 |
|
| True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense. |
|
| 26 |
|
| My own word wey bi true nor dey good, but na di yuzles words yu like. |
|
| 27 |
|
| Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well. |
|
| 28 |
|
| Make yu look mi for face, I nor go lie give yu. |
|
| 29 |
|
| Yu don try well-well, stop to tink bad tins Nor kondemn mi again, bikos I dey rite. |
|
| 30 |
|
| Yu feel sey I dey lie? Yu feel sey I nor know rite from wrong? |
|
|
: |
| 1 | | 2 | | 3 | | 4 | | 5 | | 6 | | 7 | | 8 | | 9 | | 10 | | 11 | | 12 | | 13 | | 14 | | 15 | | 16 | | 17 | | 18 | | 19 | | 20 | | 21 | | 22 | | 23 | | 24 | | 25 | | 26 | | 27 | | 28 | | 29 | | 30 | 1
1
1 |
|
|---|
|
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/006.mp3
42
6