|
| 1 |
|
| “Evritin wey man dey do for dis life nor bi struggol? Abi awa days nor bi like savant wey dem hire to work? |
|
| 2 |
|
| Like savant wey dey wait make nite kwik kom; like worker wey dey wait make dem pay am. |
|
| 3 |
|
| Mont to mont, I nor get anytin to live for; evry nite dey kause pain for mi. |
|
| 4 |
|
| Wen I sleep, I dey tink dey sey, ‘Wen day go take break?’ I dey waka for nite dey wait make day break. |
|
| 5 |
|
| Worm don full my body, sickness don kover my body with dirty; my body don skata with sore. |
|
| 6 |
|
| My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope. |
|
| 7 |
|
| My God! Make Yu remember sey my life bi like breeze and my happiness don end. |
|
| 8 |
|
| Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go. |
|
| 9 |
|
| As kloud dey vanish, na so who die nor dey kom back again. |
|
| 10 |
|
| E nor go ever kom back to en house and nobody go si am again. |
|
| 11 |
|
| “No! I nor go fit klose my mout; I dey vex for my spirit, so I must tok. I must tok as e dey pain mi for my mind. |
|
| 12 |
|
| Why Yu put mi for kage make pipol dey look mi? I bi wota juju? |
|
| 13 |
|
| Make I sey my bed go give mi rest and my pillow go reduce my komplain? |
|
| 14 |
|
| But Yu still dey make mi fear for dream; yor vishon dey make mi fear well-well. |
|
| 15 |
|
| E betta make I kill mysef, dan dis kind wiked life wey I dey live. |
|
| 16 |
|
| I don taya for life; I nor go live forever. Abeg make yu live mi, bikos my life nor good. |
|
| 17 |
|
| “Wetin bi man wey Yu dey worry for? Why Yu dey borda yorsef with di tin wey Yu kreate? |
|
| 18 |
|
| Yu dey visit am for morning and evritime, Yu won try or test am. |
|
| 19 |
|
| Nor look mi again, make Yu leave mi alone, so dat I go swallow my own spit. |
|
| 20 |
|
| Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu? |
|
| 21 |
|
| Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.” |
|
|
: |
| 1 | | 2 | | 3 | | 4 | | 5 | | 6 | | 7 | | 8 | | 9 | | 10 | | 11 | | 12 | | 13 | | 14 | | 15 | | 16 | | 17 | | 18 | | 19 | | 20 | | 21 | 1
1
1 |
|
|---|
|
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/job/007.mp3
42
7