Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book. |
| 2 |
| Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever. |
| 3 |
| My strong warrior! Make yu karry yor swod kon appear with yor glory and majesty! |
| 4 |
| Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand. |
| 5 |
| Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg. |
| 6 |
| My God, yor throne go dey forever and ever. Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom. |
| 7 |
| Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin. |
| 8 |
| Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der. |
| 9 |
| Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side! |
| 10 |
| All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far. |
| 11 |
| Bikos una prince dey happy for una beauti. Make una honor am, bikos na-im bi una oga. |
| 12 |
| Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem. |
| 13 |
| Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot wey dem make with gold. |
| 14 |
| Den dem go take am go meet di king as e wear di fine klot with di virgins wey follow am for back |
| 15 |
| and dem go happy dey celebrate as dem dey enter di king palis! |
| 16 |
| Dia sons go bi king afta dia papa and dem go rule ova many lands. |
| 17 |
| I go make evry generashon honor and remember yor name and pipol go praiz yu forever and ever. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/psalms/045.mp3
150
45