Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure. |
| 2 |
| But for mi, my heart almost fail mi and my faith don nearly vanish, |
| 3 |
| bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked. |
| 4 |
| E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong. |
| 5 |
| Dem nor dey face trobol like oda pipol or si wahala like evry oda pesin. |
| 6 |
| Dem wear pride like shain for neck kon wear yanga like belt for waist. |
| 7 |
| Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about. |
| 8 |
| Evritin wey dem dey do and tok, na only about wiked tins and as dem dey proud, evritin wey dem wont, na to kill oda pipol. |
| 9 |
| Dem dey boast like sey dem dey stay heaven and dey bihave like sey na dem get di world, |
| 10 |
| so even God pipol dey bilive evritin wey dis wiked pipol dey tok. |
| 11 |
| Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?” |
| 12 |
| Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty. |
| 13 |
| So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin! |
| 14 |
| Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.” |
| 15 |
| If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu. |
| 16 |
| So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more! |
| 17 |
| Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol. |
| 18 |
| True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall. |
| 19 |
| Na wons God go take distroy and trowey dem down with fear. |
| 20 |
| So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break. |
| 21 |
| Yes, my heart dey bitter and I dey feel pain for inside my body. |
| 22 |
| I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense. |
| 23 |
| Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand. |
| 24 |
| Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey. |
| 25 |
| Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart. |
| 26 |
| My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever. |
| 27 |
| So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am. |
| 28 |
| But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/psalms/073.mp3
150
73