Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens. |
| 2 |
| Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu. |
| 3 |
| Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place, |
| 4 |
| I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?” |
| 5 |
| Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor. |
| 6 |
| Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol; |
| 7 |
| all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked, |
| 8 |
| di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota. |
| 9 |
| Oga awa God, yor greatness full di whole world. |
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/psalms/008.mp3
150
8