Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back. |
| 2 |
| Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins. |
| 3 |
| Yu nor dey vex for dem again and Yu nor show dem yor vexnashon. |
| 4 |
| My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us! |
| 5 |
| Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren? |
| 6 |
| Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu? |
| 7 |
| My God, make Yu show us yor loyal love! Pour yor salvashon for awa head! |
| 8 |
| I go listin to wetin Oga God tok, bikos E go make peace with en pipol; doz wey dey obey am, so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways. |
| 9 |
| True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again. |
| 10 |
| Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda. |
| 11 |
| Trut dey kom out from di world and raitiousness dey smile kom down from heaven. |
| 12 |
| Yes, God dey pour en blessings kom down, so awa land go produce betta-betta food again. |
| 13 |
| Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/psalms/085.mp3
150
85