|
| 1 |
|
| I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish. |
|
| 2 |
|
| Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens. |
|
| 3 |
|
| God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose. I don promise am sey: |
|
| 4 |
|
| ‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ” |
|
| 5 |
|
| So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good. |
|
| 6 |
|
| My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God? |
|
| 7 |
|
| Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne. |
|
| 8 |
|
| My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good. |
|
| 9 |
|
| Na Yu dey rule di sea and kontrol dia waves. |
|
| 10 |
|
| Yu distroy and kill Rahab and Yu skata all yor enemies with yor mighty hand. |
|
| 11 |
|
| Na Yu get di heavens and di eart; evritin wey dey di eart na yor own, bikos na Yu kreate all of dem. |
|
| 12 |
|
| Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name. |
|
| 13 |
|
| Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well! Wons Yu raiz yor rite hand wey get pawa, Yu dey always dey win. |
|
| 14 |
|
| Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail. |
|
| 15 |
|
| Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem. |
|
| 16 |
|
| Dem dey happy evriday bikos of di wonderful tins wey Yu dey do and yor raitiousness dey save dem. |
|
| 17 |
|
| Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong and bikos Yu favor us, wi dey always win. |
|
| 18 |
|
| Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king. |
|
| 19 |
|
| Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king. |
|
| 20 |
|
| I don si my savant David and I don anoint am with my holy oil. |
|
| 21 |
|
| I go support am with my hand and with my hand wey get pawa, I go make am strong. |
|
| 22 |
|
| En enemies nor go fit win am and wiked pipol pawa nor go fit opress am. |
|
| 23 |
|
| I go distroy pipol wey dey tok against am kon kill doz wey hate am. |
|
| 24 |
|
| My goodness and love wey nor dey fail, go dey with am and with my authority, e go grow with pawa. |
|
| 25 |
|
| I go make am rule many kingdoms and en pawa go strong well-well. |
|
| 26 |
|
| Den e go koll mi kon sey, ‘Yu bi my Papa, my God and di Rock wey dey save mi.’ |
|
| 27 |
|
| I go make am my first-born and bikos I choose am as king, na-im pipol go praiz pass for di whole world. |
|
| 28 |
|
| I go love and dey kind to am forever and my kovenant with am, nor go ever end. |
|
| 29 |
|
| I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end. |
|
| 30 |
|
| But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand and disobey my laws; |
|
| 31 |
|
| if dem nor gri follow my ways or do wetin I tok, |
|
| 32 |
|
| I go ponish dem with rod kon flog dem with kane, bikos of dia sturbones and sins. |
|
| 33 |
|
| But I nor go stop to love am or forget di promise wey I make with am. |
|
| 34 |
|
| No! I nor go break my promise; I nor go take back one singol word wey I tok. |
|
| 35 |
|
| Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie: |
|
| 36 |
|
| en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun. |
|
| 37 |
|
| E go dey forever like di moon and di sky go bi witness to show how I really dey faithful!” |
|
| 38 |
|
| But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren. Yu dey vex with di king wey Yu anoint. |
|
| 39 |
|
| Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust. |
|
| 40 |
|
| Yu don break di wall wey dey guide am kon distroy evritin wey dey protet am. |
|
| 41 |
|
| Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye. |
|
| 42 |
|
| Yu don give en enemies pawa kon make dem dey happy. |
|
| 43 |
|
| Yu make sure sey en swod nor mean anytin and Yu nor gri help am for war again. |
|
| 44 |
|
| Yu don end en glory kon trowey and skata en throne. |
|
| 45 |
|
| Yu don make am old before en time kon disgrace am for publik. |
|
| 46 |
|
| So, my God, na how long dis tins go happen? Yu go hide yor face forever, abi Yu go just dey vex like dat? |
|
| 47 |
|
| Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin! |
|
| 48 |
|
| Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa. |
|
| 49 |
|
| So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David? |
|
| 50 |
|
| Make Yu konsida how dem dey disgrace yor savant and how I go must bear all di curse wey pipol dey curse mi. |
|
| 51 |
|
| Yor enemies dey laf and fool mi. Anywhere wey di king wey Yu anoint go, na so-so laf dem dey laf am. |
|
| 52 |
|
| But with all dis tins wey dey happen, na God wi go praiz forever and ever! Amen and Amen! |
|
|
|
|