“Make yu make di altar with akasia wood. Yu go build am with four korna and as e wide rish seven fit six inches, na so too e go long rish. And e go high rish four fit six inches.
Make yu guide dem with twenty bronze post kon put dem on-top anoda twenty bronze stand, den hang di curtains with silva hook wey dem join with di silva rod wey join di post.
Na di same tin una go do for di nort side for di kourtyard; di curtains go bi one hundred and fifty fit wey dem support with twenty post wey stand on-top di bronze, with silva hook and di rods for all di post.
“For di kourtyard gate, make yu put curtain wey long rish thirty fit. Yu go make am with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with fine design and e go get four post with four bottom.
“Make yu go kommand Israel pipol make dem give yu pure oil wey dem press komot from olive plant kon pour am for di lamp, so dat di lamps go always dey give lite.
Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”