E go long rish one fit and half and na so too e go wide rish; e go bi four korna. En horns go bi three fit for di four korna wey bi di same wood as di altar.
Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu.
Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
“Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem.
Yu go kollect dis money from Israel pipol kon use dem take maintain di Tabanako. Bikos of dis, Israel pipol go always dey Oga God mind and E go klean una life.”
“Make yu selet betta spices like: twelf and half pounds of pure myrrh, sinamon wey get betta smell and make e bi six and one kwota pounds, sugarcane go bi six and one kwota pounds,
Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu.