God sey, “Dis na wetin yu go do, so dat Israel pipol go bilive sey na di Oga God wey bi dia grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob God, appear to yu.”
God still tell am, “Make yu put yor hand inside yor dress.” So e put en hand inside en dress and wen e bring am kom out, e kon get diziz and di hand dey white like snow!
And if dem nor bilive dis two signs or listin to yu, make yu take small wota from River Nile kon pour am for dry groun. Den di wota wey yu fetch from di river go turn to blood as yu dey pour am.”
Den Oga God kon dey vex with Moses, so E ask am, “Wot about yor broda Aaron wey kom from Levi tribe? I know sey e sabi tok well-well. E dey kom meet yu and wen e si yu, e go happy well-well.
Den Moses go back go meet en wife papa, Jetro kon tell am, “Make yu allow mi go back to my family for Egypt kon shek if dem still dey alive.” Jetro ansa Moses, “Make peace follow yu go.”
God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.
But en wife Zipporah kut en son skin with knife kon take am tosh Moses leg, den e sey, “True-true, I don take yu from deat hand and yu bi my husband wey I marry with blood.”