Who bi dis wey hold en love dey waka kom from di desert? I wake yu up from under di apple tree where yor mama for born yu. For der, yor mama dey kry with pain, wen e dey born yu.
Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.
I bi wall before and my breast stand like towa where dem dey keep tins put, so wen ever my love look mi, e dey always dey happy, bikos of wetin e dey si for my body.
But na only mi get my vineyard and Solomon nor nid to pay 1,000 silva koin. But I go give two hundred silva koin to di pipol wey dey kare for di vines.