Twenty-five years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di new year wey bi di fourteent year afta dem skata Jerusalem, God kon tosh mi with en hand and E take mi enter di town.
E kon tell mi, “Man pikin! Listin well-well and look evritin wey I dey show yu, bikos dis na di rizin why dem bring yu kom der, so dat yu go tell Israel pipol evritin wey yu si.”
I si wall wey dey round di temple for outside. Di man take en stik wey e take dey measure, wey long rish ten fit kon measure di wall. Di wall high and tick rish ten fit.
For en front, e get one road wey pesin fit pass and three guard-room dey der. Each room na like skware wey bi ten and half fit and di wall wey separate dem tick pass eight fit. Afta di guard-room, anoda road dey wey long pass ten fit and yu go pass der go di big room wey face di temple.
E measure di room for di gate and na fourteen fit. And na dis room end di gate wey dey near di temple, but di end side for di wall tick pass three fit.
Small-small whole dey di outside wall for all di rooms and di inside wall wey dey between di rooms. Dem karve palm trees for di inside wall wey face di road.
Di man karry mi pass di gate enter di kourt. Na thirty rooms dem build join di wall for outside and for dia front, e get one place where dem pak stone full
E get one gate wey dem dey pass go di kourt for inside. E measure from di first gate go rish di sekond and na one hundred and seventy-five fit for di east and di nort.
Di three guard-room wey dey di passage side; di wall wey divide dem plus di big room, all of dem na di same size with doz wey dey for di east gate. Di gate lengt na eighty seven and half fit and e wide pass forty-three fit.
Di big room, di window and di tree wey dem karve put, bi like di ones wey dey di east gate. Na seven steps yu go pass before yu go rish di gate and di big room face di kourtyard for di end.
For di oda side for di kourtyard from di nort gate, anoda road dey wey dem dey pass go inside di kourt, just as e bi for di east. Di man kon measure how dem two far from each oda and na one hundred and seventy-five fit.
For der, e still get one gate wey dem fit pass go inside di kourtyard. Di man measure how e take far from di sekond gate and na one hundred and seventy-five fit.
En guard-room, en big room and di wall for inside, na di same measurement like di oda gates. Windows still dey der and for di big room too. Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit.
Like di odas, e still get guide rooms, walls wey dem design for inside, big room and windows for evriwhere: Di lengt pass eighty seven fit and e wide pass forty-three fit.
For di kourtyard for outside, e get one small room wey dem build join di gate for inside for di nort side. Yu fit from der go di big room wey face di kourt and na der dem for dey wosh di animals wey dem won burn as sakrifice.
For dis big room, four tabol dey der; two der for each side for di room. Na for dis tabol dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice; weda dem won burn or sakrifice am for sin or as ofrin.
Di four tabol for di small room where dem for dey prepare di ofrin wey dem won burn, na stone dem take make dem. Dem long pass two fit; wide pass two fit and high pass one fit. All di knife wey dem take dey kill di animals, dey on-top di tabols.
Den di man take mi enter di room for inside. E get two rooms for inside di kourt, one face sout near di nort gate and di oda one face nort near di sout gate.
while di one wey face nort, na for di priest wey dey serve for di altar. All di priest na Zadok shidren-shidren; na dem bi di only pipol for Levi tribe wey fit go serve God for inside en temple.”
Di man measure inside di kourt and e wide and long rish one hundred and seventy-five fit. Di temple dey for di west side and di altar dey di temple front.
Steps dey wey pesin dey pass go di room for inside wey long rish thirty-five fit and e almost wide rish twenty fit. Two marks dey der: One for each of di side where dem for dey pass enter.