Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar.
As di man waka go di east side with en tape, e measure 1,000 and seven hundred and fifty fit, and e sey make I waka pass am. Di wota rish mi for my leg.
Den e measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit kon sey make I enter and di wota kon rish mi for my knee. E measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit and dis time di wota kon rish my waist.
E still measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit, den di wota kon turn river and I nor fit cross am. E too deep to cross escept yu sabi swim.
E tell mi, “Dis wota dey flow go di east, den from der go Jordan River Valley kon enter di Dead Sea. Afta di wota don flow go di Dead Sea wey get salt taste, di sea go kon turn to fresh wota.
Anywhere di wota flow go, animals and fish wey dey dat place, go still dey alive. Di wota go make di Dead Sea wota fresh and anywhere dis wota flow go, evritin for der, go get life.
For each side for di river, difren trees dey grow for der. Dia leaf nor go dry and dia fruit nor go fall, but dem go dey produce good food evry mont and dia leaf go dey cure doz wey dey sick, bikos di wota wey dey survive dem dey flow kom from di temple.”
Di boundary for east na from sout between Damaskus and Hauran with Jordan River wey bi boundary between Israel land for west and Gilead for east go rish Tamar for di Dead Sea.
Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.