Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| God tell Moses: |
| 2 |
| “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen woman born and di pikin na boy, e go dey unklean for seven days, bikos di mama nor dey klean wen e dey mestrate. |
| 3 |
| For di eight day, dem go sekonsaiz di pikin. |
| 4 |
| Bikos of di blood wey e lost, di woman go stay for thirty-three days, before e go dey klean. E must nor tosh anytin wey dey holy and e nor go enter di Tabanako, until di day wey dem go santify am, don komplete. |
| 5 |
| If e born girl, e go dey unklean for fourteen days as e bi wen e dey mestrate and e go stay for sixty-six days, before e go dey klean. |
| 6 |
| “ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin. |
| 7 |
| Di priest go give God di ofrin kon do di sakrifice, so dat e go dey holy. Dis na wetin di woman go do afta e don born. |
| 8 |
| “ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ” |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/leviticus/012.mp3
27
12