Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| God tell Moses: |
| 2 |
| “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen man don give ensef to God to take fulfil di special vow wey e make, di pesin go dey free afta e don pay dis money, |
| 3 |
| bikos man wey bi from twenty years go rish sixty years, na fifty shekel e go pay akordin to di shekel wey dem dey take for di temple. |
| 4 |
| If di pesin na woman, na thirty shekel e go pay. |
| 5 |
| If di pesin na from five years go rish twenty years; for man, na twenty shekel and for woman, na ten shekel e go pay. |
| 6 |
| If di pesin na from one mont go rish five years; for man, na five shekel and for woman; na three shekel e go pay. |
| 7 |
| If di pesin na from sixty years go up, if na man, na fifteen shekel and woman, na ten shekel e go pay. |
| 8 |
| If e nor get money take pay en vow, e must take di pesin to di priest and di priest go reduce di money, akordin to wetin di pesin go fit pay. |
| 9 |
| “ ‘If na animal e vow sey e go give God as ofrin, den anytin wey e give to God from dis animal go dey holy. |
| 10 |
| And anybody wey make dis vow, nor go use anoda animal take replace am, weda na good for bad or bad for good. If e go use anoda animal, den di normal one and di ones wey e shange am to, go dey holy. |
| 11 |
| If wetin e vow na animal wey nor klean; wey e nor go fit give as ofrin to God, den e go make di animal stand before di priest, |
| 12 |
| di priest go kon fix prize for am, weda e good or bad and na di prize wey di priest tok, go bi di final prize. |
| 13 |
| If di pesin won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join. |
| 14 |
| “ ‘Wen pesin dedikate en house to God, di priest go fix di prize weda e good or bad and di prize go bi di final prize. |
| 15 |
| If di pesin wey dedikate di house won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join. |
| 16 |
| “ ‘If anybody dedikate one part of en field to God, di priest go fix di prize akordin to di nomba of seed wey dem go fit plant and e go bi ten silva for evry twenty kilogram for barley. |
| 17 |
| If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize. |
| 18 |
| If e dedikate am leta, di priest go kakulate di money akordin to di years wey remain before di next Sabat year, den e go reduce di prize. |
| 19 |
| If di pesin wey dedikate di field won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join. |
| 20 |
| If dem sell di field give anoda pesin, e nor go fit buy am back. |
| 21 |
| For di year wey dem dey free pipol, di field go kon bi God own forever; so e go kon bi di priest own. |
| 22 |
| If anybody dedikate field wey dem buy give God, |
| 23 |
| di priest go kakulate di money akordin to di nomba of years wey remain before di next Sabat year and di pesin must pay di money for dat same day; na God get di money. |
| 24 |
| Dem go give di field back to di pesin wey really get am or en shidren-shidren for di year wen dem dey free pipol. |
| 25 |
| Di priest go fix all di prize, just as dem tok for di sanctuary. |
| 26 |
| “ ‘Di first pikin for evry animal na God own, so make anybody nor dedikate am to God as ofrin from en mind. Weda na melu or kattle, na God get am. |
| 27 |
| But animal wey nor klean, dem go fit buy en first pikin back for di normal prize kon add twenty percent join. If e nor buy am back, dem go sell am give anoda pesin for di normal prize. |
| 28 |
| “ ‘Make anybody nor sell or buy wetin dem don dedikate give God without kondishon. Weda na human being, animal or land, bikos na God own forever. |
| 29 |
| Even if na human being, if dem dedikate am without any kondishon, dem nor go fit buy am back; dem must kill-am. |
| 30 |
| “ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own. |
| 31 |
| If anybody one buy am back, e must pay di normal prize kon add twenty percent join. |
| 32 |
| One out of evry ten animal wey dey stay house, go bi God own. Wen dem don kount di animals finish, di tent one go bi God own. |
| 33 |
| Di owner nor go arrange di animals, so dat dem go fit choose di bad one and make e nor shange any one wey dem choose. If e shange any animal for anoda one, den di two animal go bi God own and e nor go fit buy dem back.’ ” |
| 34 |
| Dis na di kommand wey God give Moses for Mount Sinai and na for Israel pipol. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/leviticus/027.mp3
27
27