“Go kommand Israel pipol sey, ‘Dis na di pipol wey una go remove from di kamp: pipol wey get diziz for skin, doz wey dey discharge and evribody wey nor dey klean, bikos e go tosh dead body.
But if di pesin don die and e nor get broda or sista wey di oda pesin go pay give, e go gi-am to God priests. Dis money na with di ram wey dem go take do sakrifice to make di pesin wey sin, holy.
di man must take en wife to di priest and e must bring di ofrin wey woman nid to give wey bi: one from evry Efah barley wey dem divide into ten. E nor go pour olive oil on-top or put any incense, bikos di ofrin na for pesin wey yu suspet and yu won know di trut.
Den e go pour some holy wota for inside one bowl wey dem make with klay kon pak some san wey dey groun for di Tabanako put for di wota den e go bitter.
or wen di man suspet sey en wife dey sleep with anoda man; den di man must make sure sey di woman stand before God, while di priest go do di sakrifice.