Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey, |
| 2 |
| “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.” |
| 3 |
| Na dis John Profet Isaya tok about sey, “One pesin dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make God road strait.’ ” |
| 4 |
| John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop. |
| 5 |
| Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am |
| 6 |
| and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins. |
| 7 |
| But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom? |
| 8 |
| Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God, |
| 9 |
| make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren! |
| 10 |
| Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire. |
| 11 |
| “I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire. |
| 12 |
| Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.” |
| 13 |
| Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River. |
| 14 |
| But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?” |
| 15 |
| Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am. |
| 16 |
| As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head. |
| 17 |
| Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.” |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/matthew/003.mp3
28
3