Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Wen Sabat Day don pass, Mary Magdalin, Mary wey bi James and Salome mama kon buy some tins wey dey send well-well, make dem go rub am for Jesus body, make e nor for smell. |
| 2 |
| For early morning on Sunday, as sun just dey kom out, dem kon go di place wey dem beri Jesus put. |
| 3 |
| Dem kon dey ask each oda as dem dey go sey, “Who go help us roll di stone komot from di grave mout?” |
| 4 |
| But wen dem look, dem si sey, dem don already roll di stone komot. |
| 5 |
| As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem. |
| 6 |
| But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before. |
| 7 |
| Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.” |
| 8 |
| Di wimen kom out kon run from di grave side, bikos dem sopraiz and fear dey katch dem. Dem nor fit tell anybody anytin, bikos dem still dey fear. |
| 9 |
| [For early morning on Sunday, afta Jesus don wake-up, e first appear to Mary Magdalin wey e drive seven demon komot for en body. |
| 10 |
| For where di pipol wey dey follow Jesus dey mourn and kry dey, Mary Magdalin kon go tell dem wetin happen. |
| 11 |
| Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive. |
| 12 |
| Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town. |
| 13 |
| Dem go back go tell di rest pipol, but di pipol nor still bilive dem. |
| 14 |
| Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart. |
| 15 |
| Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody. |
| 16 |
| Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am. |
| 17 |
| Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn; |
| 18 |
| dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.” |
| 19 |
| Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side. |
| 20 |
| Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.] |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/mark/016.mp3
16
16