Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice.
So wen wi dey celebrate Passova, make wi nor do am with di old yist wey bi wikedness and bad belle, but make wi do am with di fresh bread wey nor get yist, wey bi trut and betta mind.
But I nor dey tok about pipol wey bad, wiked, dey serve juju and get long-trot for dis world. If to sey na dem I dey tok about, den una nid to komot for dis world.
But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.