Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free. |
| 2 |
| Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again. |
| 3 |
| And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok. |
| 4 |
| Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace. |
| 5 |
| Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye. |
| 6 |
| For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love. |
| 7 |
| Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut? |
| 8 |
| Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis! |
| 9 |
| Na small yist dey make bread raiz! |
| 10 |
| I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi. |
| 11 |
| Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol. |
| 12 |
| I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef! |
| 13 |
| My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda. |
| 14 |
| Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.” |
| 15 |
| But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake. |
| 16 |
| I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont. |
| 17 |
| Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont. |
| 18 |
| But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again. |
| 19 |
| Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; |
| 20 |
| to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; |
| 21 |
| bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom! |
| 22 |
| But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, |
| 23 |
| gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins. |
| 24 |
| Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do. |
| 25 |
| If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont. |
| 26 |
| Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/galatians/005.mp3
6
5