Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan, |
| 2 |
| plus Naftali Efraim, Manasseh and all Judah land go rish di sea for far. |
| 3 |
| God show am Negev and di valley for Jeriko; di town wey get palm tree and Zoar land. |
| 4 |
| Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.” |
| 5 |
| So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok. |
| 6 |
| God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.” |
| 7 |
| Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy. |
| 8 |
| Israel pipol mourn for Moses for thirty days inside Moab wildaness; den dem kon stop to mourn for Moses. |
| 9 |
| Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses. |
| 10 |
| E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face. |
| 11 |
| God send am go do many signs and wonders for di king for Egypt, en ofisas and for di whole land. |
| 12 |
| E nor get any oda profet wey don fit do all di strong and mighty tins wey Moses do for Israel pipol present. |
| Save Notes |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/deuteronomy/034.mp3
34
34