Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody. |
| 2 |
| Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God. |
| 3 |
| Dis kind tin good and na wetin God awa Savior dey like, |
| 4 |
| bikos E wont make evribody dey save and undastand di trut. |
| 5 |
| Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda. |
| 6 |
| E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish. |
| 7 |
| Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie). |
| 8 |
| So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel. |
| 9 |
| I wont make wimen dey dress well with sef kontrol. Nor make yeye hair style; nor wear too mush gold or stones and klot wey dear well-well. |
| 10 |
| Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi. |
| 11 |
| Make wimen dey kwayet and listin well as dem dey learn. |
| 12 |
| I nor allow woman tish or give dem authority ova men. Make dem kwayet dey listin, |
| 13 |
| bikos na Adam God first kreate, nor bi Eve. |
| 14 |
| And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world. |
| 15 |
| But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef. |
| Save Notes |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/1timothy/002.mp3
6
2