Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well. |
| 2 |
| So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well. |
| 3 |
| Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una. |
| 4 |
| Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win. |
| 5 |
| Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una. |
| 6 |
| “Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite, |
| 7 |
| or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem! |
| 8 |
| But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today. |
| 9 |
| “For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today. |
| 10 |
| Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise. |
| 11 |
| Make una dey very kareful! Make una love di Oga wey bi una God! |
| 12 |
| “If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some, |
| 13 |
| den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una. |
| 14 |
| “Make una listin, I go soon die. Una know with all una heart and body sey evritin wey God promise sey E go do, E don do am for us! |
| 15 |
| And na so, E don do evritin wey E promise una sey E go do for una, but if una disobey, God go bring all di judgement for una head, until E distroy una from dis good land wey di Oga una God give una. |
| 16 |
| If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.” |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/joshua/023.mp3
24
23