Nigerian Pidgin Bible 2019
|
| 1 |
| Israel pipol sin against God again, so E kon allow Filistia pipol rule dem for forty years. |
| 2 |
| For dat time, Manoah, one man wey kom from Dan tribe, dey stay for Zorah. E nor get any pikin, bikos en wife neva born. |
| 3 |
| God angel appear to Manoah wife kon tell am, “Even doh yu neva fit born pikin, yu go soon get belle and yu go born boy. |
| 4 |
| So make yu dey kareful and make yu nor drink wine or any oda strong drink or chop any food wey dem dey forbid. |
| 5 |
| Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God as Nazirite. E go save Israel pipol from Filistia pipol hand.” |
| 6 |
| Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name. |
| 7 |
| But e tell mi sey, ‘I go get belle kon born boy.’ E still sey, ‘Make I nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid, bikos from di day wen I go born di pikin go rish di day wey e go die, dem go dedikate am give God as Nazirite.’ ” |
| 8 |
| Den Manoah pray give God, “My God! Abeg, make yor angel kom again kon tell us more tins wey wi go do about di pikin, wen dem don born am.” |
| 9 |
| God do wetin Manoah ask for and en angel kom back kon meet di woman wen e sidan for field. Dat time, en husband Manoah, nor dey with am. |
| 10 |
| So di woman run go tell en husband kwik-kwik sey, “Di man wey appear to mi dat day, don kom again!” |
| 11 |
| So Manoah get up kon follow en wife and wen e si di angel, e kon sey, “Na yu bi di man wey tok to my wife dat day?” Di angel ansa, “Yes! Na mi.” |
| 12 |
| Den Manoah sey, “If wetin yu tok so happen, wish kind tins di boy go dey do and wish kind life e go live?” |
| 13 |
| God angel ansa, “Make sure sey, yor wife do di tins wey I sey make e do. |
| 14 |
| E must nor chop anytin wey dem make from grape vine; make e nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid.” |
| 15 |
| Den Manoah tell God angel, “Abeg stay here make wi kill and kook one small goat make yu chop.” |
| 16 |
| Di angel ansa, “I go stay, but I nor go chop anytin. Instead, make yu kook and burn am as ofrin give God.” (Manoah tok like dis, bikos e nor know sey na God angel dey with am.) |
| 17 |
| Den Manoah ask God angel, “Wetin bi yor name, so dat wi go honor yu wen all dis tins don happen.” |
| 18 |
| Di angel ansa, “Why yu won know my name? My name too dey wonderful to undastand.” |
| 19 |
| Den Manoah take small goat and some korn kon offa dem for di altar on-top rock as ofrin to God wey dey do wonders. |
| 20 |
| As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun. |
| 21 |
| Na den dem kon know sey di man na God angel, so e nor appear to dem again. |
| 22 |
| Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!” |
| 23 |
| But di wife ansa, “If God won kill us, E nor for asept awa burnt ofrin and E nor for appear to us kon tell us all dis wonderful tins or do dis mirakle.” |
| 24 |
| So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am. |
| 25 |
| God Spirit gi-am pawa and e dey stay for Dan wey dey between Zorah and Eshtaol. |
|
| Save Note |
https://beblia.bible:81/BibleAudio/nigerianpidgin/judges/013.mp3
21
13