So make yu baf well-well, rub oil wey dey scent kon dress well. Den go where e for dey work. But nor let am know sey yu dey der until e don chop finish.
Wen e don ready to go sleep, look di place wey e go sleep put. Den pul di klot e take kover en leg make yu sleep near am. E go tell yu wetin yu go do.”
Boaz ansa, “My pikin! Make God bless yu! Dis one wey yu do so, betta pass evritin wey yu don do before. Bikos yu nor even tink to marry any of di oda men, weda dem get money or not.
But make yu stay here dis nite. Wen day break, if e agri sey e go marry yu, den e good like dat. But if e nor gri, I promise sey as long as God dey alive, I go marry yu. So make yu sleep till day go break.”
So Rut sleep near am until morning rish. E wake-up wen day neva break well-well, bikos Boaz sey, “I nor wont make pipol know sey woman kom meet mi for here.”
Den e tell am, “Make yu spread yor skaf.” Rut kon do as e tok. So Boaz kon measure rice wey rish eight pounds put for di skaf and karry am put for Rut shoulder, so e kon karry am go house